Translate

Sunday, March 31, 2019

Ranieri wahala jabrata after Napoli match

Napoli don use AS Roma defence tey wipe yansh after they trash dem 4-1 for dia house. Di defeat dey pile many wahala for di newly appointed boss Claudio Ranieri.

Goal ball from Milik, Mertens, Fabian and Younes nai sink Roma despite say Perotti burst net from di penalty spot.

"We know say e dey very difficult, but we still dey try work hard to make sure say we do our best, yan Ranieri. My opponent tear race faster and harder to collect di ball first. I no regret taking di job at all."

Ranieri be return for di second time to coach di club after say dem fire Eusebio Di Francesco. 

Roma throway Di Francesco after him lose to local rivals Lazio by 3-0. Wetin add salt to injury na di fact say dem comot for UEFA Champions League knock out stage after FC Porto wipe dem

Saturday, March 30, 2019

Allegri don put mouth for Ronaldo latest injury wahala

Juventus boss Massimiliano Allegri don yan say Cristiano Ronaldo fit no play dia Champions League match against Ajax, unto say di five time Ballon d'Or winner suffer injury during dis international break wey just pass so.

During Portugal match against Serbia, dem comot Ronaldo for first half after e be like say he develop thigh injury.

Allegri reveal say he don already dey sweat for yansh for di matter: "On Monday we go do some tests for am to know how e wan be from there.

But e clear say my star man fit miss our first leg against Ajax for di Champions League quarter final stages. 

Me and him know say I no go play am if he no dey fully fit before di match. I no go risk am. Because I no go wan use only one game take spoil di rest of dis season."

Juventus don already dey shine eye korokoro for who dem go use tey replace Ronaldo for dia upcoming matches against Empoli, Cagliari, AC Milan and Ajax first leg.

Di two players wey Man United no go sell according to Ole

Ole Gunner Solskjaer don yan say e no go ever allow Paul Pogba and Marcus Rashford go during di upcoming transfer window. Despite di big rumor say Real Madrid don bid £125m for Pogba head and Barcelona wan still buy Rashford for £100m, Solskjaer say Man U no go fit afford to let dem comot from Old Trafford dis summer.

E be like say di new Man United manager know say di two of dem dey very crucial to am as he dey ready to bring success back to di club. He wants build him team around both of dem. Na wetin Ole talk about am be dis: "I get strong mind say Pogba and Rashford fit achieve anything wey dem want in football for Manchester United. 

To achieve wetin we don first do before in di past, na him be our aim as a club. Na di expectations wey we get for mind be dat. We want build strong team wey go fit match di history of di club.

Na true say we get plenty players wey we fit build di team around. But Pogba and Rashford na dem me wan build my team around. Dem dey very important to our future."

Right now, Rashford and him crew dey yan with Man United over contract extension. Rumor dey say he want make dem dey pay am £150k per week.

Although say Pogba still get 2 more years for him contract, contract extension tori don already start.

Friday, March 29, 2019

Higuain send message give him bad belle pipo

Gonzalo Higuain don shoot he shot at di pipo we dey yab am because say he hang him boot for Argentina national team.

Di 31 year old striker wey join Chelsea dis January from Juventus on a loan deal, burst net for Argentina 31 times in 75 appearances. Although say dis him record sweet well well, some pipo still no like am unto say he miss many correct goals for di Argentina. Dem still dey yab am for di chance we he throway for World Cup final 2014 as well as Copa America 2015.

Explaining he decision concerning him retirement, he talk for interview say: "My time with Argentina don end after I sidon look am well well. Before I announce am, I let coach Lionel Scolani know why.

I make dis decision because I wan enjoy my family. I wan dey spend many time with my daughter, and at di same time I feel say I don give my country everything."

He also talk say: "Di premier league dey very competitive, and he go really like to enjoy am." 

Thursday, March 28, 2019

Man United don confirm Ole as full time manager

Manchester United just announce say dem don make dia current caretaker boss dia new full time manager. Dem knack am with three years contract.

Ole Gunnar Solskjaer burst net 126 times in 366 appearance for Man United between 1996 to 2007. He con later become dia reserve team coach until 2010. After dis time, him break light no show for Old Trafford until December last year when dem appoint am as caretaker boss.

Speaking to some tatafo pipo for news conference, Solskjaer say he dey jolly well well as dem make am full time manager job: "Since I come back to Manchester United, e be like say na my house I dey. Na very big honour for me to be a United player, and even to con begin my coaching career here.

I don gather a lot of fantastic experience since di last few months. And I wan to thank all di players, staff and coaches wey I don work with so far. Dis na di job wey I don dream about, and I dey super excited to get d chance to tey coach di club for a long time."

Since he appointment, Solskjaer don gather more points than any oda manager during dis time. Him don get 14 victories and 2 ogbolor in 19 games.

Sterling knee down beg oda clubs to fight against racism

Manchester City player Raheem Sterling dey beg English clubs to shine touch for racism matter. Say con say he want make oda European clubs dey see as dem tey dey fight against racism.

Sterling and some of him teammates suffer heavy racial chants when dem play against Montenegro dis Saturday wey pass so. Di former Liverpool winger con vex react as he use him hand tey drag him ears when he score England fifth goal for di match. Di Three Lions trash Montenegro 5-1 for Montenegro house.


Speaking to some tatafo pipo for news conference, di England international con talk say: "banning 1 or 2 person no change anything concerning di matter. I think there gats be more serious punishment for any person wey go curse another person race. Say con say e no dey enough to just cancel 1 or 2 pipo season tickets."

Cole vex knack blow to Van Gaal back

Andrew Cole don knack blow back to Louis Van Gaal after di Dutchman talk say Ole Guunar Solskjaer still dey make Manchester United play like Mourinho's pack-the-bus style.

Solskjaer don lose only one out of di 14 premier league matches since him overtake Jose Mourinho for December. Despite dis kind sweet record, Van Gaal say di style of ball wey di Norwegian dey use no dey attacking. He say di style no resemble di Almighty Sir Alex Ferguson own.

Because of di way wey Van Gaal tey open mouth condem Ole style of ball, former Man United forward Andrew Cole con vex scatter yan him mind. And wetin he yan, con dey arrange Louis Van Gaal for one corner:

"When I open my eyes korokoro tey look wetin Louis Van Gaal yan, cold dey catch me. Di way I see di matter be say, e depend on wetin you feel say na im be attacking football.

Many pipo go agree with me say d way wey Man United don tey play in d last 5 years, don dey a little bit more attacking if you compare am. If to say na me dey in charge of United matter, I go don permanently package Ole d coaching job since. Dis na because I feel say di Norwegian na di best coach wey Man U don get since Epa Ferguson retire."

Gabby Agbonlahor don retire from ball

Tori dey reach us now say former Aston Villa player, Gabby Agbonlahor don retire from football at di age of 32. 

Di former England international play many of him ball for Aston Villa when dem dey premier league. Las las when dem even go relegation, he still stay with dem.

Anyway, Agbonlahor be don dey without club since him contract expire last season. The final time we him wear dia jersey na December for 2017.

To confirm dis tori, him carry mouth yan am for him Instagram. Na wetin him talk be dis:

"Di time don come for me to finally retire from ball, and kukuma dey watch Aston Villa as dia pickin. If to say dem tell me for school say I go knack ball in nearly 400 league appearance, carry di club record premier league goal scorer wear for head, be di skippo of di club and wear England shirt tey play for dia senior team, I go for laff well well.

I wan tell all staff of di club wey I don work with, my ex-teammates, and all di fans, a very big thank you.

To con dey play ball for another club, or play against dis my Aston Villa, na wetin I no go fit see myself dey do. But based on tradition, na to dey look forward to wetin di future hold las las."

Agbonlahor knack ball in 391 appearance for Aston Villa and burst net 86 times. Him also get chance play for England senior team 3 times.