Goal ball from Milik, Mertens, Fabian and Younes nai sink Roma despite say Perotti burst net from di penalty spot.
"We know say e dey very difficult, but we still dey try work hard to make sure say we do our best, yan Ranieri. My opponent tear race faster and harder to collect di ball first. I no regret taking di job at all."
Ranieri be return for di second time to coach di club after say dem fire Eusebio Di Francesco.
Roma throway Di Francesco after him lose to local rivals Lazio by 3-0. Wetin add salt to injury na di fact say dem comot for UEFA Champions League knock out stage after FC Porto wipe dem
No comments:
Post a Comment