Translate

Monday, April 1, 2019

Big gbegae as Herrera knack pre-contract agreement with PSG

Heavy rumor don dey shele say Ander Herrera go sign for PSG when dis season end. Di Manchester United midfielder contract dey expire by dis summer and tori don dey land since say he go waka go PSG next season as a free agent.

Why Man United no fit give am a new contract? Dis particular question fit dey run for your mind right now. Wetin happen be say, di Spanaird dey ask for £200,000-a-week improved contract, according to di tori wey we hear. But e be like say Man U no wan pay di guy pass £170,000 including bonuses.

Di French giant no wan slack at all, unto say dem need to boaster dia midfield wella. As a result, nai make dem shine dia korokoro eye for Herrera body unto say him go fit enter dia team well.

Ole Solskjaer don give Herrera 13 starts since him come di club since December. Di coach be get am for mind make Herrera stay beyond dis season. But as di oga-at-di-top wey dey Man United no wan meet di player demand, e no get wetin Ole go fit do.

No comments:

Post a Comment