Translate

Thursday, March 28, 2019

Cole vex knack blow to Van Gaal back

Andrew Cole don knack blow back to Louis Van Gaal after di Dutchman talk say Ole Guunar Solskjaer still dey make Manchester United play like Mourinho's pack-the-bus style.

Solskjaer don lose only one out of di 14 premier league matches since him overtake Jose Mourinho for December. Despite dis kind sweet record, Van Gaal say di style of ball wey di Norwegian dey use no dey attacking. He say di style no resemble di Almighty Sir Alex Ferguson own.

Because of di way wey Van Gaal tey open mouth condem Ole style of ball, former Man United forward Andrew Cole con vex scatter yan him mind. And wetin he yan, con dey arrange Louis Van Gaal for one corner:

"When I open my eyes korokoro tey look wetin Louis Van Gaal yan, cold dey catch me. Di way I see di matter be say, e depend on wetin you feel say na im be attacking football.

Many pipo go agree with me say d way wey Man United don tey play in d last 5 years, don dey a little bit more attacking if you compare am. If to say na me dey in charge of United matter, I go don permanently package Ole d coaching job since. Dis na because I feel say di Norwegian na di best coach wey Man U don get since Epa Ferguson retire."

Gabby Agbonlahor don retire from ball

Tori dey reach us now say former Aston Villa player, Gabby Agbonlahor don retire from football at di age of 32. 

Di former England international play many of him ball for Aston Villa when dem dey premier league. Las las when dem even go relegation, he still stay with dem.

Anyway, Agbonlahor be don dey without club since him contract expire last season. The final time we him wear dia jersey na December for 2017.

To confirm dis tori, him carry mouth yan am for him Instagram. Na wetin him talk be dis:

"Di time don come for me to finally retire from ball, and kukuma dey watch Aston Villa as dia pickin. If to say dem tell me for school say I go knack ball in nearly 400 league appearance, carry di club record premier league goal scorer wear for head, be di skippo of di club and wear England shirt tey play for dia senior team, I go for laff well well.

I wan tell all staff of di club wey I don work with, my ex-teammates, and all di fans, a very big thank you.

To con dey play ball for another club, or play against dis my Aston Villa, na wetin I no go fit see myself dey do. But based on tradition, na to dey look forward to wetin di future hold las las."

Agbonlahor knack ball in 391 appearance for Aston Villa and burst net 86 times. Him also get chance play for England senior team 3 times.